Thursday, February 26, 2009

Cockroach Day!

Sorry oh all my very speacial readers as e don tey since i reach this my blog.

Many tins don dey happen 4 my life since then n na serious wa i don dey!
E get as my day just b yesterday...so as i reach house i com say i make i loosen my self abi how dey dey talk am..."Unwind" with movie wen i don watch like one hundred times before "JENIFA"......anyways as i siddon 4 ground dey chop biscuit dey drink juice dey laugh......the next thing i just see one lonely cockroach waka come myside....my laughter b wan choke me...i come jump up.....the next thing d cockroach wan come show me say im get some skills wen i never see b4....e run around 4 circle....come do im wing one two up n down ...i swear im look me straight into my eyes ...b4 i blink e don fly reach d other side of my room..b4 all this one i don carry ammunition(long broom).....i must confess i dey fear cockroach pass anything....as d cockroack fly reach d other side of my room ... e just dissapear...i come look look look...i no see am again. after i don feel safe again continue to dey watch my JENIFA.......
25mins come pass then una no go believe wetin happen to a whole me wen dey fear cockroack pass rat! i just feel one tin dey tickle my back i come jump up ahhhhhh Mr cockroach don show again and na 4 inside my cloth e enter to tap me say im don arrive......Ogene.....Jesu....Olodumare......Osanobulah...i almost faint!i just dey jump dey jump....after all dat jumping shey una go expect say i go slaugther d cockroach send am to people wen dey chop cockroach mk dem use am take cook soup for such an attrocity...but guess wat....d cockroach dribble me dribble me..come run commot from d room....hummm! as for me na that one better pass..as i no fit kill am mk e go another person room go disturb them.

Yes...shame on me to dey fear cockroach and anything wen resemble dier family...i no dey shame put.....lol... but be assured e no go happen again lie lie...i don flit my room so no cockroach or em extended family fashioned against me can prosper in my room!


I remain ur Sweetest Edo Sista
Nothing do u !
Nothing do me!!

2 comments:

  1. lollllllllllllllll abaya so na common cockroach make u dey hyperventilte,
    wetin u go do if u see d one wey dey talk?
    ehn wetin u go do????? :)

    ReplyDelete
  2. @ LG: if i see d one wen dey talk ... for that one i go just faint.

    ReplyDelete

Write am as u feel am 4 ur mind!