Friday, February 13, 2009

To all my Sweetest Sistas + Happy St. Falen-tines Day!!

For the past one week now...i just dey hear some kind nonsense stories abt how some people wen i know dey suffer suffer inside something wen suppose be good thing...anyhow this na my advise to all dem sweet sistas out dere.....


If man want u, e no get anybody wen go fit stop am.




If man no want you, e no get anything wen go make am dey with u.

No dey make stupid excuses for anyman stupid behavior.

Make u use ur head take make decision so as to keep ur heart from any breakage.

No try change ursef 4 relationship wen no get head n tail.

Jeje na the answer.

If u breakup with man cos e take u do yeye …. My dear …e no get as una wan b friends..tell am make e carry him wahala dey go with him friendship.

Person wen true true b ur friend no go take u do yeye…therefore say bye bye to rubbish.

If u feel say man wen u dey with just dey drag u up n down like goat
….my sister 4 u to think am in d first place e mean say…na so ur situation true true be. E wise make u accept the true situation ….and find solution.

No stay with man n dey think 4 ur mind say one day one day things go better. After one more year u go vex with urself say u no waka wen u wan waka b4.

Na only urself u fit control 4 inside relationship…u no fit control anoda person.

Run from any man wen get plenty plenty children ..from plenty plenty women. If him no marry dem wen e give them belle…why u think say ur own wan come different.

Make sure say u get ur own set of friends…make dem dey different from im own friends.

Make sure say u draw line wen go guide how any man go to treat u. no dey take rubbish from anyman.

If anytin dey bother u, make sure say u open ur mouth talk am(no go dey shout shout)

No be everything u go open ur mouth tell man…because one day na one day e go take am curse u!!!

No woman fit change any man…change dey come from person belle n heart. Na personal decision.

Never u make any man feel say e important pass u…even if e go all the school for this world from Harvard to Lincoln or even if him Job better pass ur own.

No treat any man like a..”QUASI-god.
.Na man e b…nothing more…nothing less.

Make no man define who u b. define ursef by ursef!

No borrow another person MAN. Because d owner go collect am one day..or d man go run by him self go him owner!

Listen to this all ye SHAPIROS: “If the man wen u dey with…cheat on him ex-girlfriend or wife…come be with u….my sister wear ur taekwondo belt cos that man go soon find who him and am go dey cheat on u.”



Man go treat u d way wen u let am treat u.

No be all men get LEG and ATTITUDE !
we still get some angels wen be like this out there!!!

No be only u suppose dey bend for relationship…according to d oyinbo man: Compromise is a street.


Wen u end one relationship…make u take out time take treat ur brokenheart & e no dey interesting to dey carry wahala up n down..…. No carry putmanto ,iron box, Ghana must go of trouble from ur old relationship enter ur new relationship…drop them 4 outside…infact put dem 4 dustbin !

No find man wen go complete u…relationship na with two whole people….find person wen go compliment u…no go dey find supplementary person

Dating na fun…e no mean say the thing must end up 4 marriage…sha use ur head.


No dey make urself totally available to man…cos as a human being e go start to dey take u 4granted small small.

No go dey commit to man wen u know say e no b d kind person u wan b with.If he no b wetin u want keep am 4 ur side …open ur eyes well well( I no say make u turn to
oh…just use ur sense).

Make sure u share this my talk with other sweet sistas…U go make person smile
, u go also make person re-think the choice wen she just makeand u go make anoda woman prepare hersef.






According to man Aristotle: e talk say Love is composed of a single soul inhabiting two bodies.




LOVE NA GOOD THING.....AND AS ST.FALEN-TINE DON LAND MAKE WE ALL MAKE SURE SAY WE DEY CELEBRATE AM WITH TRUE HAPPINESS FROM OUR BELLE!!! N O DECEIVE YA SEF!!




HAPPY FALEN-TINES DAY!



I remain ur sweetest edo sista !
Nothing do me !!
Nothing do u…!!!

6 comments:

  1. na true talk be dis. Na must read for all ladies make dem for get common sense to handle man. Kudos to the author and make u continue to make us get sense with these words of widom.

    ReplyDelete
  2. This is male bashing!! I am not happy....but some of it na true talk sha...especially "If the man wen u dey with…cheat on him ex-girlfriend or wife…come be with u….my sister wear ur taekwondo belt cos that man go soon find who him and am go dey cheat on u"...this go happen 100% of the time no failing. The funny thing be say no matter how many times u are warned una go still do am sha.

    ReplyDelete
  3. lollllllllll happy faa'lentine dear'
    norrin do u

    ReplyDelete
  4. lol..but I agree this is man bashing

    ReplyDelete
  5. @anonymous & Dabizniz: Winsh kind male bashing...abeg my sweet sistas need 2 hear true story....i don tire 2 settle matter!

    ReplyDelete
  6. Correct my sister...
    Men no go gree now..
    But na we know pass.. Cos teh person wey shit no dey know, but the person wey carry am no dey forget am lailai..
    Nice work jare my sister..Keep it up.

    ReplyDelete

Write am as u feel am 4 ur mind!