Monday, February 9, 2009

Jesu Christi+Pidgin Phonetics

Na Wa......Wetin b this????? I dey browse jeje on my own wen i see this wonderful foto!! Wetin this man wan talk? Na woman e no get or na money e dey find!! Jesu Christi abeg deliver us from all this madness.....

This aside....una no go believe wetin happen right ontop my head for saloon .... i dey one of those posh saloons in lagos dey do my hair. Na one onyibo guy(Lebanese) dey do my hair so i guess wen one woman enter the saloon she come feel the need to speak phonetics...Only 4 d woman to speak this english with plenty phonetics....Excuse me is there Chance.....I almost scatter laughter ... but i say make i just repect my self cos person when fit speak that kind english and still dey blow phonetics untop am obviously na person wen get home trouble!! Lol....
Anyways i remain ur Sweetest Edo Sista
Nothing do me!
Nothing do u!!

3 comments:

  1. May God deliver us 4rm ourselves (ami)
    lolll@is there chance, ur stylist for answer, 'there isnt chance or chance is there :)
    * omoge how is d goings' :)

    ReplyDelete
  2. @LG: Many many thank you as u dey always read my blog...e dey make me happy well well say person dey laugh plenty plenty on my account! Make u try be the no 1 person wen go follow my blog...i for bribe u if i know where ur house dey! lol

    ReplyDelete
  3. Na wa o. Everybody must show say dem sabi obodoyibo. Ha ha ha .......cant stop laughing.

    ReplyDelete

Write am as u feel am 4 ur mind!